by Hillary Afolayan
To mess for public dey sweet but if dem catch u, no be small embarrassment o! Just follow dis guidelines and u are on ur way to being a star in dis profession.
1. Wen u enter a hall, check d wind direction, if na closed hall wit air condition or fan, beta 4 u. Maximum impact.
2. Make sure say u sidon face d wind direction.
3. Make sure say u get enof leg space. U go soon knw why!
4. Form ajebo by crossin ur legs every now and then.
5. U don ready 2 execute, try hold am until time wey d hall dey noisy incase ur mess na d type wey dey sound like AK47.
6. Now carefuly cross ur leg, right over left.
7. Elevate d right yansh.
8. Release small (sound check)
9. If no sound, allow make d mess flow steady.
10. Allow time 4 proper circulation.
NOTE or Caution to take after Farting in Public
1. Make sure say no be u be d first person to complain.
2. Wen pple begin dey shout “Jesus” who do dis wan. E no go better for d person wey do dis kind thin,” simply ask “why som persons no fit respect demselves 4 public places?na wa o”
3. No shout pass odas if not u go become suspect.
4. Take style disengage from d area, relocate to another zone and repeat d exercise!trust me,u will go places wit dis profession. D world must hear of u more dan Micheal Jackson.
Voice of my personal experience #crazyme#😂😂😂😂😂
(Steps to take when need to fart in public arise)